If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: NSCDC tell politicians for Enugu to maintain peace during election
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
2023 Election

NSCDC tell politicians for Enugu to maintain peace during election

Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don tell politicians for Enugu state to keep peace for Saturday, March 18 elections. Comman...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo March 17, 2023
Updated March 17, 2023 at 5:47 PM
Share
NSCDC tell politicians for Enugu to maintain peace during election
SHARE

NSCDC tell politicians for Enugu to maintain peace during election
Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don tell politicians for Enugu state to keep peace for Saturday, March 18 elections. Commandant of NSCDC Enugu State Command, Mr Mohammed Dada, talk dis one when im dey yan with journalists for office on Friday.

Dada say experience don show say governorship elections wey dey for state level dey generate more heat pass presidential elections. E come talk say make all key players for di election get am for mind say security agencies go dey catch any person or group wey wan cause wahala during the election.

"I wan remind politicians say no condition go fit allow thuggery. I wan call on parents to guide their pikin wella against any politician wey wan carry dem do bad thing," Dada talk.

He come charge traditional rulers, town union leaders and religious leaders to tell youths say make dem no do any act wey go lead to lawlessness because if dem do am, law go catch dem.

Dada come still call on NSCDC personnel to do their work well and dem go dey discipline anybody wey no follow due process. E come still talk say make everybody wey wan vote come out and vote, say NSCDC dey provide security.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: NSCDC tell politicians for Enugu to maintain peace during election

Tags: 2023 Election, Politics
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us