Nigerian rapper, Odumodublvck, don blow Rema se na im be im agba picker for advice.
Odumodublvck yarn say though im senior Rema with six years, anytime wey Rema open mouth talk, e dey listen well well. The rapper come reveal say Rema don show am say na which way person old reach no be that go make am turn legend.
For em X handle, Odumodublvck write say: "I senior Rema with six years but when him dey talk I dey pay full attention. E get many thing wey him tell me wey I never hear anybody tell me. Not even my father and mother.
"And trust me, I don hear many advice. I repeat OG no be by age."
Prime 9ja Online report say na only Odumodublvck and Shallipopi Rema carry for im second album wey e name na ‘He Is’ wey drop on Thursday. Odumodublvck dey one song wey dem call ‘War Machine.’
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Odumodublvck Hail Rema As Agba Picker