Nigerian Bulk Electricity Trading (NBET), wey dey under Federal Ministry of Power, don appoint John Akinnawo as dia new acting Managing Director.
NBET talk dis one for statement wey dem release on Thursday.
Dis new appointment dey come after Nnaemeka Ewolukwa don retire after e don spend eight years dey work for di place.
Before dem appoint am, Akinnawo don get over 25 years experience dey work for big big companies wey dey make plenty money for public, private and international development sector. E be di person wey dey lead Origination, Contract Management & Administration Department for NBET now now.
Make una remember say na President Muhammadu Buhari bin appoint Ewelukwa as Managing Director of NBET for 2020.
Before dem appoint am as Managing Director, e bin be di first person wey dey do di work of General Counsel & Company Secretary for NBET, wey Federal Government of Nigeria (FGN) set up to dey sell electricity for bulk inside Nigeria electricity market.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: NBET Get New Acting Boss