Kano State don get new kings as Governor Abba Kabir Yusuf sign bill wey create three new second-class emirates for di state.
Dis bill wey dem call Kano State Emirates Council Establishment Bill 2024, come after di state House of Assembly pass am on Tuesday. Di bill wey Deputy Speaker Muhammad Bello Bututu sponsor, create Rano, Gaya and Karaye as second-class emirates wey go answer to di Kano Emir wey be first-class.
Di new emirates of Rano go consist of Rano, Bunkure and Kibiya local government areas, while Gaya Emirate go get Gaya, Albasu and Ajingi local government areas. Karaye Emirate go be made of Karaye and Rogo local government areas.
These new second-class emirs go fit advise di Kano Emir for important matters like how to keep peace for dia people, settle boundary problems and any wahala between communities wey fight ova land or anything wey threaten how people dey live together and their culture for dia areas. Even religious matters, dem fit yarn mouth for am.
Di bill come talk say everything wey the first-class and second-class emirs do, the governor through the commissioner for local governments go get to approve am.
One important thing to note na say di Bichi Emirate wey former Governor Abdullahi Umar Ganduje create, no dey part of this new thing. Di new law wey dem pass cancel that Bichi Emirate.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Kano Get New Emirs, Gov Sign Law for Three New Emirates