Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) Registrar, Professor Ishaq Oloyede, vex plenti for how some universities for Nigeria dey admit students anyhow. Oloyede yarn say dis kain thing dey shame Nigeria for international level.
The Professor yarn dis tori when im dey host committee of pro-chancellors of state universities in Nigeria (COPSUN) for JAMB headquarters for Abuja.
As Prime 9ja Online report, na for latest JAMB bulletin dem announce this tori.
Oloyede come yarn say some people wey dem dey call graduates never even see the four walls of any university before, because of how corruption full ground for admission process. But JAMB don catch over 3,000 cases like that already.
Because of this kain wahala, Oloyede come beg COPSUN make dem clamp down on any secret admission wey universities dey do. Im talk say dis kind thing no only bad for the educational system, but e still taarnish the image of Nigeria for abroad.
For the meeting, Oloyede acknowledge the kain problem wey lack of money dey cause for state universities. Im come yarn say if dem no settle am, e fit spoil the whole education system for Nigeria.
Oloyede also use that opportunity yarn COPSUN people about the upcoming policy meeting wey go happen on Thursday, July 18, 2024.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: JAMB Catch 3,000 Fake Graduates for Nigeria, Wahala for Uni wey Dey Do Backdoor Admission