If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: FEMA Warn Residents for Abuja Make Dem Relocate, Say Flood for Rivers Around FCT Fit Cause Wahala
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Naija

FEMA Warn Residents for Abuja Make Dem Relocate, Say Flood for Rivers Around FCT Fit Cause Wahala

Federal Capital Territory Emergency Management Department (FEMD) don yarn dis one for inside statement wey dem release for Abuja ...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo July 07, 2024
Updated July 7, 2024 at 4:09 PM
Share
FEMA Warn Residents for Abuja Make Dem Relocate, Say Flood for Rivers Around FCT Fit Cause Wahala
SHARE
FEMA Warn Residents for Abuja Make Dem Relocate, Say Flood for Rivers Around FCT Fit Cause Wahala

Federal Capital Territory Emergency Management Department (FEMD) don yarn dis one for inside statement wey dem release for Abuja on Sunday. Dem warn residents wey dey live near river and water ways for FCT make dem gbalae comot for there go high grounds so flood no go kpai dem property and even kpai person.

Acting Director-General of the department, Mrs Florence Wenegieme, na im yarn dis tori. Dis kain warning follow wetin National Inland Waterways Authority (NIWA) yarn about di high water levels wey dey inside rivers and lagoon for di whole country.

Wenegieme tok say especially boat people and di passengers wey dem dey carry for dia boat make dem take note of di high water levels and make sure say dem follow all di safety rules wey dey on top water for inside country and make sure say dem always wear life jacket.

She come still yarn again about di heavy rain wey fit fall and cause flood for some states wey dey for different parts of di country from July 6 to July 10, 2024, and she beg pipo make dem take precaution.

Di Acting D-G yarn say di flood prediction wey National Flood Early Warning Systems (FEWS) Centre for Federal Ministry of Environment do, show say na di states wey dey near Abuja na dem go likely feel di effect of di flood pass.

She come still yarn say di prediction show specifically say Zaria, Jaji and Saminaka for Kaduna State; Ado for Nasarawa and Ibaji for Kogi State fit get heavy rain wey go fit cause flood for that period.

Because of di flood wey dem predict fit happen, Wenegieme come yarn say flood wey come from rivers for di states wey dey surround Abuja – Kogi, Kaduna, Niger and Nasarawa – fit reach Abuja.

She beg pipo for Abuja make dem hear di warning wey FEMD dey give and make dem do something about am so dat flood no go catch dem unawares.

Wenegieme come still advice pipo wey dey drive say make dem no try to drive pass flood wey rain cause for road.

Last last, she beg pipo for Abuja say if flood happen and dem dey for any kain danger, make dem call di emergency number wey FEMD get wey be 112 for free.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: FEMA Warn Residents for Abuja Make Dem Relocate, Say Flood for Rivers Around FCT Fit Cause Wahala

Tags: Naija
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us