Di Court of Appeal wey sit down for Abuja don nullify di expulsion of factional speaker, Martin Amaewhule and 24 others from di Rivers State House of Assembly wey Rivers State High Court do.
Wan panel of three pipo for di appellate court wey Jimi Olukayode-Bada lead, tok say di trial court no get di jurisdiction to hear di case, as na federal high court suppose handle such matters.
Di court tok say Section 272(3) of di Constitution give Federal High Court power to determine whether di seat of House of Assembly member don vacant.
Dem tok say na only Federal High Court get di exclusive jurisdiction to determine if di seats don vacant.
According to di court, di mention of di Federal High Court for Section 272 (3) of di Constitution automatically exclude all state high courts from di jurisdiction.
Di appellate court tok say di exparte order wey dem make without jurisdiction na null and void.
Di appeal na di 25 Pro-Wike lawmakers file, led by factional speaker of di Rivers State House of Assembly, Martin Amaewhule and 24 others, dem dey seek to vacate di order of high court for Port Harcourt wey restrain dem from parading demselves as lawmakers.
We go remember say on May 30, 2024, Justice Charles Wali, of di Rivers State High Court, restrain di lawmakers for Amaewhule’s faction from conducting legislative sittings anywhere, including di legislative quarters.
Di judge also restrain Siminalayi Fubara, governor of Rivers, from interfacing with or accepting resolutions and bills from di 25 lawmakers.
Di suit na di Speaker of di Rivers State House of Assembly, Rt. Hon Victor Oko Jumbo, and two other lawmakers, Sokari Goodboy and Orubienimigha Adolphus Timothy, wey loyal to Governor Fubara, file.
Di court also tok say all di laws wey Amaewhule and others make go be nullity until dem determine di matter.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Apeal Court Don Cancel Expulsion of Amaewhule, 24 Odas from Rivers Assembly