No be small thing as four people die on Friday for one accident wey involve Toyota Camry car for Area J3 on top Sagamu-Benin expressway.
Na Mrs Florence Okpe, wey be di Spokesperson of Federal Road Safety Corps (FRSC) for Ogun confirm di wahala give news people for Abeokuta.
Okpe explain say di accident happen around 11:40am and na because di driver dey speed too much na im make am lose control.
She talk say di vehicle wey dem mark BDG 184 FY come comot for road and turn enter swamp.
“Na total of four people, three men and one woman dey inside and all of dem die for di lone crash.
“Dem suspect say na because di driver dey speed too much na im make am lose control and di vehicle come comot for road and turn enter swamp,” na wetin she talk.
Okpe explain say dem carry di people wey die go put for Ijebu-Ode General Hospital mortuary.
Di Sector Commander, Anthony Uga, advise drivers wey dey do long journey make dem dey rest for 15 minutes after every four hours drive to avoid tiredness for road and make dem no pass di speed limit wey dem set.
E come sympathise with di families of di victims, e come tell dem make dem contact FRSC Ogbere for more information about di crash.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Four people die for lone accident for Sagamu-Benin expressway