If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Osimhen, Oshoala enta final list for Globe Soccer Awards
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Football

Osimhen, Oshoala enta final list for Globe Soccer Awards

Victor Osimhen and Asisat Oshoala don enta di final list for di 2023 Globe Soccer Awards for men and women category. Na on Monday dem crown ...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo December 12, 2023
Updated December 12, 2023 at 1:49 PM
Share
Osimhen, Oshoala enta final list for Globe Soccer Awards
SHARE

Osimhen, Oshoala enta final list for Globe Soccer Awards
Victor Osimhen and Asisat Oshoala don enta di final list for di 2023 Globe Soccer Awards for men and women category.

Na on Monday dem crown Osimhen as di best player for Africa, e dey among di 11 players wey dey fight for di Men award.

Oda players wey follow for di list na Jude Bellingham (Real Madrid), Vinícius Jr (Real Madrid), Kylian Mbappe (PSG), Mohamed Salah (Liverpool), Karim Benzema (Al-Ittihad), Lionel Messi (Inter Miami), Bernardo Silva (Man City), Kevin De Bruyne (Man City), Erling Haaland (Man City) and Cristiano Ronaldo (Al Nassr).

Osimhen dey look to become di first African player to win di Best Men’s Player for di Globe Soccer Awards.

Dem shortlist Oshoala with Aitana Bonmatí, Mary Earps, Fridolina Rolfo, Linda Caicedo, Amanda Ilestedt, Georgia Stanway, Olga Carmona, Sam Kerr and Debinha for di Women award.

Na for Monday night for Marrakech, Morocco, Oshoala wey dey play forward for Barcelona Femeni win di seventh CAF Women’s Player of the Year award.

Dem go hold di awards gala for five-star Atlantis, The Palm, on January 19, 2024 for Dubai.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Osimhen, Oshoala enta final list for Globe Soccer Awards

Tags: Football, Sports
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us