If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Kaduna State Enrol Ova 500,000 Pipo for Health Scheme
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Naija

Kaduna State Enrol Ova 500,000 Pipo for Health Scheme

Di Kaduna State Contributory Health Management Agency (KADCHMA) don talk say dem don register more than 500,000 pipo into the health scheme ...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo August 20, 2023
Updated July 5, 2024 at 9:48 AM
Share
Kaduna State Enrol Ova 500,000 Pipo for Health Scheme
SHARE

Kaduna State Enrol Ova 500,000 Pipo for Health Scheme
Di Kaduna State Contributory Health Management Agency (KADCHMA) don talk say dem don register more than 500,000 pipo into the health scheme since e start for 2020.

Abubakar Alhassan, wey be di director-general of KADCHMA, yan dis one as e be for di time wey dem dey register 120 women wey dey carry belle inside di scheme wey Lifidi Jama’a Charity Foundation arrange for Kafanchan, Kaduna state.

E talk say the number include pipo wey dey di formal and informal sectors, e add join say dem don reach 98 per cent coverage for those wey dey formal sector for di state.

“As we take relate to the informal sector, wey mostly dey make up of vulnerable groups, we never dey where we suppose dey but we dey make progress.

The KADCHMA boss praise di foundation for how dem take ensure say women wey dey carry belle no dey left out for di scheme.

“Today na 'noda milestone for us and you sabi wetin dat one mean for these women wey carry belle.

“E mean say for di next one year, these 120 women go dey go hospital dey do antenatal and e go later get to di time wey dem go born under our scheme.

“Dis one go get better effect as e take relate to how women dey take born and di small pikins for Kaduna State.

For im own comment, Bashir Idris, wey be founder and chairman of di foundation, talk say dem do dis one sake of say e dey important to always dey help pipo wey no get plenti money for society.

Mr Idris yan say e no dey better way to show God thank you for e many blessings wey dey for person life pass to help pipo wey dem neva rich.

E call on oda pipo wey get mind and oda organisations make dem join hand with government to take care of pipo wey no get much.

“If God don bless you, e dey right make you thank am by helping pipo wey no get. You no suppose get all di money for dis world before you fit think to help odas, so I wan beg odas make dem do di same thing.”

For their own talk wey separate, Paul Anya and Abdullahi Alhassan, wey be chairmen for di Christian Association of Nigeria and Jama’atu Nasril Islam for Jema’a LGA, talk say anybody wey dey look after poor pipo dey look after God.

Some of di pipo wey register wey follow yan for di event, thank di founder of di foundation sake of say e show dem love and pray make God bless am.

Di foundation still give money to 120 pipo wey blind, deaf and oda pipo wey dey get physical challenge.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Kaduna State Enrol Ova 500,000 Pipo for Health Scheme

Tags: Naija
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us