Inside the letter wey dem send, the family also dey ask for N200 million as pay for the wahala wey dem dey pass through since dem lose their son. Dem yan say Fidelis Ekata be the person wey dey bring chop for the family.
Police bin talk for press conference for Benin for March 2022 talk say their officers shoot Fidelis Ekata die for Okkenken Road, Uromi, say na notorious armed robber and jailbird dem wan arrest.
Police still yan for the conference say Fidelis Ekata run comot from Benin Correctional Facility when "#End SARS'' protest happun for October 2020.
Inside the letter wey the family send go the IGP wey dem write on August 8, 2023, the family lawyer, C.M. Uche-Enwere, yan say all the tori wey police talk against Fidelis Ekata no correct at all.
Police confam say dem receive the letter on August 15.
The family talk say Fidelis Ekata no be armed robber and e no run comot from anywhere. Dem talk say the police kill am for no reason and dem dey ask police make dem talk say wetin dem yan about the person no be true.
The family talk say, "Because dem kill Fidelis Ekata for nothing, the family don suffer, dem lose plenty tins and dem dey traumatized because e be the person wey dey bring money come house.
"Based on the sorrow wey the family get and how Fidelis Ekata take die wey dem no plan am, we dey write to tell una make una give us N200 million as compensation.
"This money na because of the killing wey una do, the loss wey we carry for body and how we dey suffer because of our family person wey die.''
The family come yan say, "If una no gree pay us the N200 million wey we dey ask for, we go carry una go court so dem fit answer our matter for the law."
Meanwhile, one letter wey one Idemudia P., wey be Superintendent of Correction for Benin Correctional Centre, sign talk say Fidelis Ekata no dey their custody before and e no run comot from anywhere.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Edo Family Petition Police Boss Ova Killing, Demand N200m Compensation