If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: NYSC DG warn Corps Members against risky journey
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Naija

NYSC DG warn Corps Members against risky journey

Di Director General of di National Youth Service Corps (NYSC), Brigadier General Yusha’u Ahmed don warn Corps Members make dem no go embark ...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo July 18, 2023
Updated July 5, 2024 at 9:48 AM
Share
NYSC DG warn Corps Members against risky journey
SHARE

NYSC DG warn Corps Members against risky journey
Di Director General of di National Youth Service Corps (NYSC), Brigadier General Yusha’u Ahmed don warn Corps Members make dem no go embark on unauthorised journey or risky adventure wey fit expose dem to danger during dia service year.

Di Director General tok dis warn as e dey address Corps Members wen e visit NYSC Orientation Camp for Fanisau Dutse, Jigawa State, North-West Nigeria.

E tok say e administration put di security and welfare of Corps Members and NYSC officials as top priority, and dem go continue to do evri evri to make sure say dem dey safe.

E tok say if e dey compulsory make dem travel, dem must obtain permission from NYSC and dem must avoid night travel.

General Ahmed advise say as dem dey travel, once e reach 6pm, make dem stop dia journey and pass di night for either military barracks, NYSC formations, police barracks or any oda safe place.

E also advise Corps Members make dem take dia personal security serious and avoid to dey associate with pipo wey get questionable character.

“Make una dey law-abiding, focus and always follow di rules and regulations wey dey for camp.

Una dey from different socio-cultural backgrounds, make una learn from one another and make friends. Una must tolerate one another because we dey expect high level of discipline from una.

Avoid drugs, cultism, fraud and oda social vices wey fit put una for trouble,” e tok.

General Ahmed also advise say make dem try dey study di needs of dia host communities and carry out projects wey go improve dia standard of living.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: NYSC DG warn Corps Members against risky journey

Tags: Naija
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us