If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Obi urge Nigerians make dem correct election wahala for Democracy Day
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Naija

Obi urge Nigerians make dem correct election wahala for Democracy Day

Labour Party presidential candidate urge Nigerians make dem take spirit of June 12 wey dem dey celebrate as Democracy Day help dem correct d...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo June 11, 2023
Updated July 5, 2024 at 9:48 AM
Share
Obi urge Nigerians make dem correct election wahala for Democracy Day
SHARE

Obi urge Nigerians make dem correct election wahala for Democracy Day
Labour Party presidential candidate urge Nigerians make dem take spirit of June 12 wey dem dey celebrate as Democracy Day help dem correct di errors of di February 25, 2023 presidential election, as di surest way to restore and deepen di country's democracy.

Obi for one Democracy Day message wey e send give Nigerians talk say "di challenge of June 12 and di dedicated Democracy Day na to ginger us make we correct di errors of our recent elections. Na di surest way to restore di confidence of our pipo for di future of our nation and di promise of true democracy."

Di presidential candidate describe June 12 as "one historic day wey suppose make we celebrate" and e talk say "on top dat day for 1993, we di pipo of Nigeria make we talk say we prefer true democracy. Even as we dey under military rule, we choose transparent voting. Our vote reflect our true choice as pipo. Our choice for dat day no get anything to do with ethnicity, religion or region."

Obi say na di qualities of di votes wey reflect di true choice of Nigerians "na im make June 12 special for our search for true democracy. Our collective choice of late Chief M. K.O Abiola as one worthy leader for di nation bin make Nigerians, governments and pipo all over di world hail us."

Di former Governor of Anambra State wey dey for court dey challenge di outcome of di presidential election, yan say "June 12 na di foundation of our long journey to nationhood as true democracy."

E come regret say "di current state of our politics dey tell us another tori. Our democracy dey face big wahala even as our nation's future dey uncertain and dangerous. We still dey find solution to too many basic problems. One of dem na di search for one credible electoral system wey go make all Nigerians believe and trust am just like June 12."

Di LP presidential candidate come tell di kontri say "make we use dis celebration of June 12 make we return to di true principles of true democratic nation. We don achieve dat one on top June 12, 1993."

In di spirit of June 12, Obi come yan say we need to put one electoral system wey go make pipo trust am. Dis na sake of di principles and core values of democracy wey dey based on top respect for di pipo's wishes as dem talk am for dia votes.

"Above all, di government suppose respect and protect di institutions of di democratic state by respecting di social contract with di pipo as we dey meet dia needs, obey dia wishes and fulfill dia responsibilities of responsible governance as di constitution talk. One important responsibility of di government na to respect di rule of law," Obi add.

E come talk say e dey regret say "we dey for one era where dis foundational principles of democracy dey under attack as impunity, violence and bloodshed plenty for our country. Di gap between our leaders and Nigerians dey grow. Di gap of trust and efficiency for our last elections na clear evidence of dis wahala."

Di challenge of June 12 and di dedicated Democracy Day na to ginger us make we correct di errors of our recent elections. Na di surest way to restore di confidence of our pipo for di future of our nation and di promise of true democracy."

Obi con advise say make we no lose hope for our democratic system to correct itself.

E come yan say e still dey committed and convinced say "New Nigeria na possible." E say our aspiration for one nation wey get equity, justice, security and peace no fit be impossicant. We get di blessings of rich human and natural resources for our kontri. Wetin we lack na leaders wey dey selfless and ready to work for di interest of di nation, sustainable development and innovative thinking wey go give every Nigerian, irrespective of tribe, religion or social class, di freedom to choose wia e wan dey and protection of life, property and rights. E say dis aspiration na real tin wey we fit achieve and e promise Nigerians say e no go ever tire to fight make we get leaders wey go give dem di priority wey dem deserve.

Obi con finish by tok say make e on behalf of Labour Party and di Obidient Movement all over di world, e wish all Nigerians happy democracy day. -Peter Obi

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Obi urge Nigerians make dem correct election wahala for Democracy Day

Tags: Naija
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us