If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Truck crash injure two for Lagos-Abeokuta expressway
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Metro

Truck crash injure two for Lagos-Abeokuta expressway

One truck don hit three motor-dem for Lagos-Abeokuta expressway, wey cause wahala. Di accident wey hapun for Ijako Market no kill anybody bu...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo April 07, 2023
Updated April 7, 2023 at 4:07 PM
Share
Truck crash injure two for Lagos-Abeokuta expressway
SHARE

Truck crash injure two for Lagos-Abeokuta expressway
One truck don hit three motor-dem for Lagos-Abeokuta expressway, wey cause wahala. Di accident wey hapun for Ijako Market no kill anybody but two people dem injured.

Temitope Oseni, wey be Owode-Ijako Unit Commander of Traffic Compliance and Enforcement Corps (TRACE) for Ogun State, na him confirm di tori wey hapun for Sango-Ota wey dey Ogun state. Ms Oseni talk say di accident hapun around 8:35am on Thursday wey be say na the beginning of Easter break period.

According to her, one truck wey be say na Iveco truck with registration number: DED 266 DC bin dey on high speed and no control and e hit three oda motor-dem. Di moto-dem na Honda Pilot SUV, marked: APP 654 HA, Nissan Primera car, marked: EH 462 MK and a Mazda bus: marked APP 392 DJ.

Ms Oseni wey talk say di accident affect seven people for di different motor-dem, say two people dem injured and five people escape.

TRACE people don carry di two injured people wey dey the different motor-dem wey di accident affect go Diamond Hospital for Ijako for proper medical attention.

Ms Oseni don warn drivers and oda motorists for dis Easter period, make dem no dey drive their motor-dem on top speed because na for Easter period, dem dey always record plenty accident.

She come add say, make motorists dey avoid reckless driving wey fit cause serious accident, make we no go mourn for Easter period.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Truck crash injure two for Lagos-Abeokuta expressway

Tags: Metro
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us