If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Sudan accuse RSF say dem attack diplomatic missions
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Africa

Sudan accuse RSF say dem attack diplomatic missions

Sudan ministry don talk say Rapid Support Forces (RSF) attack diplomatic missions headquarters for Khartoum. Dem yan say the attack wey the ...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo April 18, 2023
Updated April 18, 2023 at 5:52 PM
Share
Sudan accuse RSF say dem attack diplomatic missions
SHARE

Sudan accuse RSF say dem attack diplomatic missions.
Sudan ministry don talk say Rapid Support Forces (RSF) attack diplomatic missions headquarters for Khartoum. Dem yan say the attack wey the RSF do for residential neighbourhoods and civilian places dey put the staff of the diplomatic missions for danger.

The ministry don warn the diplomatic missions say make dem shine their eye and report any kind attack as e take happen.

On Monday, the United States embassy vehicle and the European Union ambassador to Sudan residence na im the RSF bin attack with plenty bullets.

Witnesses talk say on Tuesday the violence wey dey happen between the Sudanese army command, the presidential palace, the Khartoum International Airport, and some RSF bases for the south of the capital city Khartoum don renew.

Since April 15, Sudan don dey face serious wahala as the Sudanese army and the RSF dey fight for Khartoum and other areas outside the capital city.

The two sides don yan say the other side na im start the fight. For Merowe region for northern Sudan, the matter don vex reach where the RSF don carry military vehicles go come stay near the military airbase, the army don talk say na illegal action.

Serious quarrel don show between the Sudanese army and the RSF as e concern how dem go take integrate the RSF into the army as the framework agreement sign wey the military and civilian leaders sign for December 5, 2022 talk am.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Sudan accuse RSF say dem attack diplomatic missions

Tags: Africa, World
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us