If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Obasanjo yan say make patriots save Nigeria from dystopia
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Naija

Obasanjo yan say make patriots save Nigeria from dystopia

Obasanjo talk say e no fit keep quiet wen e dey see as Nigeria leaders dey drive di kontri go dystopia. Di former Nigerian President, wey de...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo April 06, 2023
Updated July 5, 2024 at 9:48 AM
Share
Obasanjo yan say make patriots save Nigeria from dystopia
SHARE

Obasanjo yan say make patriots save Naija from dystopia
Obasanjo talk say e no fit keep quiet wen e dey see as Nigeria leaders dey drive di kontri go dystopia. Di former Nigerian President, wey dey para for di way wey election take happen, talk say all Nigerian patriots suppose come together, join hands and save di kontri from sliding to dystopia.

E talk say, "I don old small, e no fit pass me to sitdown dey look Nigeria leaders dey lead us go dysfunction. Now na all efforts we need from all di patriots wey don dey committed to rescue di nation from di precipice. And when I look di audience, I sabi say some of una fit do am and una suppose do am."

Obasanjo say di conduct of di last election don show say di kontri dey even more divided pass wetin we tink and e advise di next government to quickly find solution wey go make di youths happy and bring peace come back to di kontri.

"E go hard for di administration wey go take over after dis one, to quickly facilitate di process of national moral rearmament and national reconciliation to appease di aggrieved and bring peace to Nigeria. Dis na di necessary things wey go help us correct di sickening and painful show of shame wey di 2023 elections produce," Obasanjo explain.

Di former president say e dey e duty to always write letter wey go help Nigeria go di right direction and make life better for all Nigerian people.

"E don become my personal obligation, to dey write letter to push Nigeria in di right direction wey go fit benefit all Nigerians. Wetin we dey expect na better society, wey go make all Nigerians to become wetin God plan for them to become."

Meanwhile, di book wey dem present for di event wey Obasanjo attend na di memoirs of Dr. Tunji Olaopa, wey be former Permanent Secretary and Director-General for National Institute for Policy and Strategic Studies (NIPSS), and na former President Obasanjo write di forward for di book.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Obasanjo yan say make patriots save Nigeria from dystopia

Tags: Naija
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us