According to Isidore Chikere, Commandant of NSCDC for Anambra state, di personnel don kpai instruction say make dem do rigorous patrol for di state during di Easter period.
Commandant Chikere yarn dis one as e dey address di 1077 personnel wey e deploy for di security operation on Thursday, for Awka.
Di Commandant say e go make sense if di officers pay special attention to places of worship, recreation areas and places wey people plenty during di period.
E come talk say di officers and men wey dem deploy for di security operation na from Operations Department, Rapid Response Squad, Counter Terrorism Unit, Disaster Management Unit, Investigation and Intelligence Department.
Other units wey dem send for di operation include Chemical Biological Radioactive Nuclear & Energy Unit, Critical National Assets & Infrastructure Protection Unit(CNAI), Anti-vandalism Unit and Special female squad.
Commandant Chikere con tell di security personnel say make dem follow Easter Celebration Operational order wey NSCDC Commandant General, Dr Abubakar Audi give.
“You go need dey professional, diligent and make sure say you discharge your duties with tact and high sense of responsibility during dis period,” e tell di officers and men.
E come urge all Area Commanders and Divisional Officers make dem ensure say dem do rigorous patrol for di areas wey dem dey in charge of, so as to make sure say lives and property dey safe.
“In addition to say make una protect all Critical National Assets and Infrastructure for una area, make una also do rigorous patrol,” Commandant Chikere add.
E come beg people wey dey for di state make dem cooperate with NSCDC and other security agencies to ensure say security dey tight.
“Use di opportunity to seek divine intervention for di country mata, and make una learn from di supreme sacrifice of Jesus Christ, so make una no do any political, social and religious violence,” e advise.
Commandant Chikere con tell members of di public say make dem do their normal activities without fear, and e release some GSM numbers make people fit call incase of any security wahala.
Di numbers na 08066769442, 08036172748, 08035913830, 08036086018, and 08035406492.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: NSCDC deploy 1077 officers for Easter security for Anambra