Mr Ayeni talk say di command tracking unit arrest di suspect based on tori wey dem get. Dem find am for Oke-Onigbin, Isin Local Government Area of Kwara, on March 24.
Ajibola dey alleged say e scam one Abdullahi Saheed of N700,000 and Ropo Gabriel of N96,000 by telling dem say e go help dem gain admission into di Nigeria Defence Academy (NDA), Kaduna.
Di suspect also deceive one Prophet Samuel Olugbemiga to give am him Toyota Picnic car for commercial transportation wey e later run comot wit.
Mr Ayeni talk say dem go soon carry di suspect go court afta dem don finish dia investigation.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: NSCDC Arrest Man Wey Impersonate Soldier to Scam Public