Di Clerk to the National Assembly (CNA), Sani Magaji Tambuwal, don send di bill for presidential assent on Wednesday via letter wey him write.
According to di tori wey we get, di letter wey him write on top di letter head of di CNA carry date of 12th April, 2023 and na to Buhari directly him address am.
Three copies of di authenticated copies of di bills, wey dem get, dey go to di president for assent and dem expect say, him go keep one and send di other two back to National Assembly for further action.
According to di 1999 Constitution, President Buhari suppose approve di bill on or before 11th May, 2023 when di 30 days window wey dem give for di important action go don expire.
If dem approve di bill, e go give legal backing to Peace Corps of Nigeria wey don dey operate based on volunteerism all these years. But now, e go be federal government own and dem go dey fund am for di name of Nigeria Peace Corps.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: NASS don send Nigerian Peace Corps bill to Buhari for assent