According to di ministry spokesman, Afonja Fatai Ajibola, di minister tok say di ministry dey important to di national security and prosperity of Nigeria.
Im say dis na through di four services wey dey under am - Nigeria Immigration Service (NIS) wey dey monitor who dey enta and commot from di kontri, ensure say people wey go fit harm Nigerians no enta di kontri.
Minista Aregbesola also say Nigeria Security Civil Defence Corps (NSCDC), dey support police and odas law enforcement agencies for fight against crime and intelligence gathering. Nigeria Correctional Service (NCoS), dey keep those wey dem don sentence lawfully or wey still dey wait trial.
Im say di Federal Fire Service (FFS) dey respond to fire and odas emergency situations. One department for di ministry dey register marriages and regulate di presence of foreigners for Nigeria.
Minista tok say though Nigeria still get security challenges, thousands of cases wey go fit cause wahala for di kontri dey addressed daily.
Di ministry Permanent Secretary, Dr. Shuaib Belgore, for im speech talk say di ministry neva get strategic plan before, but dis one wey dem get now go help Nigeria improve im security architecture.
Im say make di ministry leadership take action on di plan to achieve di objective.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Minister Aregbesola launch plan to tackle insecurity