Governor Hope Uzodimma of Imo State don urge Christians to show the sacrificial love wey Jesus Christ show im neighbour for dia relationship with di state and di nation.
Mr Uzodimma make di call for im Easter message wey e deliver for Owerri, di state capital. E come remind Christians say Easter na di foundation upon which dia faith dey build and na di hope wey dem get for salvation.
"I dey urge all of us, make we behave like Christ and show true love to our neighbour. Na so we fit repay Christ love for us," e add.
As e congratulate pipo wey dey Imo state say dem don dey alive to celebrate Easter 2023, di governor talk say di resurrection of Christ na hope of salvation for Christians.
"Dis spirit of love, sacrifice and selflessness wey dey inside di season, suppose reflect for di way we dey live our life and how we dey take relate with our fellow human beings.
"We suppose follow di universal love wey Christ show for di way we dey behave ourselves everyday," e talk.
Mr Uzodimma come tell dem say make dem use di opportunity of di Easter celebration make dem pray for di pipo wey lose dia life sake of di security crisis wey happun for di past.
"In our struggle for political power, make we remember say di pipo wey we dey try to serve need to dey alive so dem fit appreciate our services.
"No matter wetin we do, Imo go always be our state and di bond wey dey among us no go ever break.
"We suppose avoid divisive and combative attitude sake of politics and make we follow Jesus Christ example of sacrificial love," e talk.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Imo governor tell Christians make dem show love for Easter