If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: How Tinubu Take Win 2023 Election - American Diplomat
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
2023 Election

How Tinubu Take Win 2023 Election - American Diplomat

Bola Tinubu, APC Presidential candidate for the February 25 presidential election, win the election due to the plenty money wey e get, and t...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo April 06, 2023
Updated April 6, 2023 at 2:55 PM
Share
How Tinubu Take Win 2023 Election - American Diplomat
SHARE

Johnnie Carson
Bola Tinubu, APC Presidential candidate for the February 25 presidential election, win the election due to the plenty money wey e get, and the best national organisation wey e use for ground game, na wetin American diplomat, Johnnie Carson talk. Mr Carson co-led National Democratic Institute (NDI) and International Republican Institute (IRI), International Election Observation Mission wey come monitor the elections.

As dem dey yarn, Mr Carson sef talk say, unless something happen for court, Tinubu go swear in for May 29. E say for person to win for Nigeria election, like for most democracy for the world, e need three things, including plenty money, national working organisation and grass-root acceptance. Tinubu get all three during the election, while the other contenders no get all.

Mr Carson talk say for the Labour Party Presidential candidate, Mr Peter Obi no get the ground game and national organisation, but e very popular among the young, educated, urban and sophisticated people.

The diplomat talk say the presidential election wey dem do for Nigeria na one of the most competitive polls for Africa, but INEC need to improve for the next election.

Meanwhile, Lai Mohammed, the Nigerian Information Minister wey visit Mr Carson talk say INEC don improve well well with the new technology wey dem use, Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) wey cut out fraudulent votes, ghost voters and multiple votes. Mohammed also yarn say the election happen when fuel shortage, insecurity and poorly timed cash swap policy still dey ground.

The minister also visit Council on Foreign Relations, Reuters News Agency, The Politico and Zenger News where e present the government narratives on the just concluded polls, economy and foreign affairs. Dem also talk about the recent investigation wey Reuters do on the alleged secret programmes of coerced abortion of women and girls freed from insurgents’ captivity.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: How Tinubu Take Win 2023 Election - American Diplomat

Tags: 2023 Election, Politics
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us