If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Bandits kill 8 for Atak'Njei, Kaduna State
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Metro

Bandits kill 8 for Atak'Njei, Kaduna State

Bandits don kill 8 people for Atak’Njei community, Zango Kataf LGA of Kaduna State. Di attack bin happun on Wednesday by 9pm and oda pipo st...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo April 13, 2023
Updated April 13, 2023 at 6:02 PM
Share
Bandits kill 8 for Atak'Njei, Kaduna State
SHARE

Bandits kill 8 for Atak'Njei, Kaduna State
Bandits don kill 8 people for Atak’Njei community, Zango Kataf LGA of Kaduna State. Di attack bin happun on Wednesday by 9pm and oda pipo still sustain injury for di attack. Atak’Njei na di place wey dem keep palace of Agom Atyap, di highest traditional ruler for Atyap pipo.

Chairman for Zangon Kataf LGA, Francis Zimbo, wey confam di tori, decried di spades of attacks wey dey happun for di area for recent time and e call on security agencies to increase dia level of protection.

National President for Atyap Community Development Association (ACDA), Sam Achie, wey also react to di tori, don condemn di attack, describe am as barbaric. E don call on di pipo wey dey responsible to secure di area to find those wey dey behind di constant attacks and killings wey dey happun for Atyap land.

In anoda tori, troops wey dey for Operation Forest Sanity don intercept large quantity of ammunition wey bandits wan use for attack pipo. Dem konfam dis on Thursday for Kaduna.

Commissioner for Internal Security and Home Affairs, Samuel Aruwan, talk say dem intercept di ammunition based on credible intelligence wey dem get about gunrunning activities for di area. Dem konfam say dem don see more dan 2,000 rounds of ammunition wey dey for different grades for inside di vehicle.

Dem discover 1,079 rounds of 7.62mm special ammunition, 886 rounds of 7.62mm belted ammunition, 139 rounds of 7.62mm tracer ammunition and five empty AK-47 magazines inside di car.

Di driver of di vehicle, Aminu Abdullahi, don also dey for police custody for further investigations. Governor Nasir el-Rufai don hail di security forces for di interception and e don charge dem to continue with di investigations and dey take action to dismantle gunrunning networks across di state and beyond.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Bandits kill 8 for Atak'Njei, Kaduna State

Tags: Metro
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us