Fasipe talk dis tin for one open letter wey him send to Acting Governor Lucky Aiyedatiwa of Ondo State and wey him share give newsmen on Wednesday for Akure.
News Agency of Nigeria (NAN) talk say on Monday, some people, wey mostly be okada riders, throw stone kill one man wey him name na Tope Olorunfemi sake of say him crash him car kill two pipo and injure six oda pipo after him hit like five commercial motorcycles for Ijoka road by Sunday bus stop for Akure.
Di mob wey throw stones come even burn Mr Olorunfemi car.
Fasipe talk say dis no be di first time wey okada riders dey attack innocent people anytime wey accident happen between dem and motorists, especially wen di person wey drive car na young person.
Him advise di State Government to make law wey go give definite jail term for manslaughter so dat e go discourage youths from driving carelessly, and make sure say dem carry anybody wey do dis kain tin go jail.
Fasipe talk say di young people wey dey di State need assurance say dem life and property dey safe, so make di government do something now to stop di excesses of all di okada riders wey dey drive anyhow.
“Your Excellency, e no go bad to talk say okada riders for Ondo State dey bring security wahala to motorists, especially di young ones.
“Di tin wey I talk dey happen any time okada-motorist accident happen for any part of Ondo State.
"On many occasions, instead make dem try to save di life of di pipo wey get accident, di okada riders go just dey beat di person wey drive motor.
“Na only dem think say all di successful youths for Ondo State na ritualists, and na dis kain thing make dem kill Tope Olorunfemi.
"Di worst thing be say one of dem wey dey video di thing come talk say any young man wey wear cloth wey pass N150,000 na ritualist,” him talk.
Fasipe talk say e know say poverty and frustration na di main cause of di fight between okada riders and motorists for Ondo State.
“I dey beg make government fish out and prosecute di people wey kill Tope Olorunfemi, so e go serve as warning to oda okada riders wey dey like to kill person for di State.
“Di leaders of di okada union for Ondo State too, make dem sign fresh agreement say dem members no go dey do mob action anytime okada-motorist accident happen for any part of di state,” him talk.
Fasipe still talk say him dey sorry for di pipo wey lose their life for dis kain tin and for those wey wound.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Advocate say make goment stop Okada excess for Ondo State