Senator Gobir Abdullahi, wey sponsor di motion for National Park declaration Order 22, yarn say di establishment go regulate Naija unique ecosystem, fauna and flora. Di parks go also address di fast rate of disappearance and degradation of Nigeria's forest and develop adequate tourism infrastructure wey go fit compete with international standards.
According to di senator, di establishments go ensure say Nigeria biodiversity dey protected and preserve our natural heritage. E also say, di establishment na based on feasibility studies and environmental impact assessment of selected forests and game reserves for different states.
Di National Park Service Act 2004 as amended, wey allow for di concurrent of di National Assembly, give room for di establishment of di additional national parks. Di motion get di full support of senators for di plenary wey approve di parks.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Senate don approve 10 new national parks for Naija