If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: School bus wey carry children dem somersault for Lagos
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
Metro

School bus wey carry children dem somersault for Lagos

One school bus wey carry pikin wey dey between one to five years for Lagos don get accident today wey be Thursday and the occupants don sust...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo March 16, 2023
Updated March 16, 2023 at 3:34 PM
Share
School bus wey carry children dem somersault for Lagos
SHARE

School bus wey carry children dem somersault for Lagos
One school bus wey carry pikin wey dey between one to five years for Lagos don get accident today wey be Thursday and the occupants don sustain injuries. The accident happen for Surulere, Lagos for morning time. The bus with registration number KTU-465DN hit median barrier, come hit concrete wey dey hold street light before the bus somersault.

Pipo wey see the accident quick quick come dey carry pikin dem and the caregiver wey dey inside bus go Topaz Hospital wey dey near the accident scene. The driver of the bus wey get injuries run comot from the scene, e run comot because e no wan make pipo beat am.

Doctors and nurses wey dey for Topaz Hospital quick quick come attend to the pikin and caregiver dem. Dr. Sanusi Olatunbosun wey dey for duty say, "Seven pipo dey inside the school bus, three get serious injuries while four get minor injuries."

Dr Olatunbosun say, "dem don treat all of dem and dem go observe dem for two hours before dem go discharge dem." He talk say the school go pay for the medical bills of the victims.

The hospital tell the school say make dem tell pikin parents make dem dey check dem well well and make dem report any sickness wey pikin get.

Some youths join bodi push the school bus comot for middle of road so make other cars fit pass. Lagos State Emergency Management Agency people come the scene of the accident to manage traffic.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: School bus wey carry children dem somersault for Lagos

Tags: Metro
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us