Ogun Sector Commander of Federal Road Safety Corps (FRSC), Ahmed Umar confirm the tori on Tuesday for Ota, Ogun.
Umar yan say di accident happen around 7:35pm wey involve six people, two cars and two okada.
One truck wey carry cement dey go Abeokuta-Lagos Expressway wey e come lose control because e brake no gree work, e come collide with two cars and two okada.
Di people wey die na traders or people wey dey wait for bus.
“Three people die for di accident and two others dey for hospital dey receive treatment while one person no get any scratch.
“Di dead bodi dem don put for mortuary for General Hospital, Ifo, while di injured people dey receive treatment for General Hospital, Ota,” Umar yan.
Umar talk say di accident na because of over-speeding.
Mr Umar tell motor drivers say make dem no dey over-speed and make dem dey check their motor well well before dem dey take am comot for road to prevent accident.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Lorry kill 3, wound 2 for Lagos-Abeokuta expressway