Di court registrar wey im name na Oluchi Uduma, don confirm di matter to journalists wey dey for Owutu-Edda on Wednesday. She talk say, di building wey di court dey inside, documents and oda things wey get value, don turn to ashes.
Chairman for Afikpo South LGA, Chima Nkama, don also confirm di matter. E come add say, dem don carry di matter go police.
Na di Ebonyi matter be di latest one for di series of arson wey dey happun for South East. For December 2022, gunmen con burn one magistrates’ court wey dey for Owerri, Imo State, and one high court wey dey for Orlu LGA.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Hooligans don burn high court for Ebonyi state