Gerald Irona media aide, Walter Duru, tok for one message on Friday say na Abuja federal high court order make dem release di former deputy governor on bail. Duru still talk say di authorities wey dey for di correctional centre don comply with di court order.
Duru say, “Former Deputy Governor of Imo State, Gerald Irona don gain freedom. Federal High Court for FCT, Abuja na im order im release and di Nigerian Correctional Service don long comply with di order. I go still release one statement later today.”
Police accuse Irona say im and some oda people bin conspire to commit felony wey include treason, wey be say na one offence wey dem go punish you if you try am. Dem still talk say Irona dey threaten say e go make Imo State ungovernable and after im tok am, na so hoodlums begin attack di state.
Police still talk say Irona cari two land cruiser jeep wey value four hundred and Ninety three million naira wey be property of di Imo state government take do im own thing, dem still accuse am of property theft.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: Ex-Deputy Governor wey dem accuse of treason don regain freedom