If you wan use dis site, you gats gree wit di Privacy Policy and Terms of Use.
I gree
P9O Newsletter
Join Us!

Make you subscribe to our newsletter so dat you no go miss any of our stori-dem, breaking news-dem, etc...

We no dey scatter your email with plenti things. You fit comot any time.
  • Domot
  • Naija
  • Africa
  • Politiks
  • Metro
  • World
  • Lifestyle
  • Futbol
You dey Read: Brekete: APC Win Katsina Gov Election, Lado Lose To Radda
Prime 9ja Online Pidgin
Prime 9ja Online Pidgin Prime 9ja Online Pidgin
Aa
  • Metro
  • Politics
  • World
Search
  • Katigory-dem
  • _Futbol
  • _Lifestyle
  • _Word
  • _Metro
  • _Politiks
  • _Naija
  • Pej-dem
  • _Wetin We Be
  • _Kontakt Us
  • _Privasi Polisi
Follow Us
2023 Election

Brekete: APC Win Katsina Gov Election, Lado Lose To Radda

Independent National Electoral Commission (INEC) don declare Dr. Dikko Umar Radda, All Progressives Congress (APC) candidate for Katsina sta...

Chima Joseph Ugo
Chima Joseph Ugo March 19, 2023
Updated March 19, 2023 at 9:00 PM
Share
Brekete: APC Win Katsina Gov Election, Lado Lose To Radda
SHARE

APC Win Katsina Gov Election, Lado Lose To Radda
Independent National Electoral Commission (INEC) don declare Dr. Dikko Umar Radda, All Progressives Congress (APC) candidate for Katsina state, as the winner of Saturday election. 

Katsina State governorship election collation officer, Prof Muazu Abubakar Gusau, make the announcement say APC candidate get 859,892 votes while Senator Yakubu Lado of the Peoples Democratic Party (PDP) get 486,620 votes. 

Gusau talk say, "Umaru Dikko Radda of the All Progressives Congress, don meet di requirement of di law, he don win and e don dey elected". Parties wey follow trail far behind na NNPP wey get 8,263 votes; PRP get 4,226 votes; SDP get 1,049 votes and LP get 560 votes among others.

Gusau talk say, the total number of registered voters for di state na 3,516,719 while accredited voters na 1,399,291. He add say, di total valid votes na 1,365,848, rejected votes na 20,579 and total votes cast na 1,386,427. He talk say results for 88 polling units no follow because of over-voting and violence, among others.

As di result dey come in from the 34 local government areas of the state, Radda win for 33 while Senator Yakubu Lado of the Peoples Democratic Party (PDP) win for only one local government of Kankara, where he get 27984 votes and Radda get 21,652 votes.

Dis election wey happen on Saturday 18th na peaceful one except for some issues of violence and over-voting wey happen for different polling units, e make dem cancel some of di results. The Katsina governorship election result different from February 25 presidential election wey ruling APC lose to opposition PDP.

Source: Prime 9ja Online Pidgin: Brekete: APC Win Katsina Gov Election, Lado Lose To Radda

Tags: 2023 Election, Politics
Share this Article
Facebook WhatsApp TwitterEmail Print

You fit like these ones too

Facebook Like
Twitter Follow
Pinterest Pin
Telegram Subscribe
Prime 9ja Online Pidgin

Subscribe to our newsletter make you receive our latest tori dem for your email wen e still fresh.

Pej-dem

  • Wetin We Be
  • Kontakt Us
  • Privasi Polisi

Katigories

  • Naija
  • Politiks
  • Wọld

© 2024 Prime 9ja Online Pidgin by Prime 9ja Online Media - All Rights Reserved.

Follow Us