Yusuf Abdullahi wey be the sector commander for Federal Road Safety Corps (FRSC) for Bauchi State, come talk say five other pipo get injury wey serious well well.
Abdullahi come talk say na one Ford Galaxy wey be commercial vehicle dem dey use for transportation naim carry nine pipo.
"For the accident, na eight men and one woman carry am. Four men die for the spot, while the other five – four men and one woman - get serious injury," Abdullahi talk.
Him come talk say the tyre of the vehicle burst and naim make the driver lose control. The accident happen for around 10:30am.
According to the sector commander, dem no too waste time clear the road and even talk say dem don carry the dead bodi and the injured pipo go Dass General Hospital.
Him con tell motorist make dem dey careful and dey follow the traffic rule and regulations so that accident no go dey happen again.
Source: Prime 9ja Online Pidgin: 4 pipo die for motor accident for Bauchi